As e dey Go

‘The Mbappe wey I know no be promise and fail’- PSG Presido

Published

on

PSG Presido, oga Nasser Al-Khelaifi don come outside with alarm dey hala say, the Kylian Mbappe wey him know o, no be promise and fail therefore all diswan wey him dey talk say him wan leave on top free transfer, him no understand again.

Mbappe wey be PSG top scorer for the last season don talk say him no wan renew him contract with PSG and if dem no allow am go now, him go likely waka on top free transfer next season.

If Kylian Mbappe leave dis transfer window, him go become the second big name wey go leave the Paris club dis window after Lionel Messi wey waka leave the club straight to Inter Miami inside American League.

Mbappe fit become the second high profile player to leave PSG after Messi

PSG always want to make Mbappe dem biggest player sotay dem nak am one of the biggest contract in European football history. But still on still the bobo no wan stay wan place even dey threaten to leave on top free transfer.

Na diswan don make PSG Presido come outside dey talk say: All diswan wey dem dey talk say Mbappe wan comot or not, me I no understand. Mbappe don promise me say him no go leave PSG on free transfer. And the Mbappe wey I know no be promise and fail.

According to the Presido, Mbappe na correct boy wey get respect and pet of dat respect na say him no go leave the club on top free transfer because him big pass dat level. Him say PSG want Mbappe to stay and dem go do everything to make am stay.

Na Real Madrid be the likely club wey don dey show interest to sign Mbappe although many people believe say if Sheikh Jassim finally buy Manchester United, dem too go fit buy am.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version