As e dey Go

Na for Manchester United my career finish kpatakpata – Schneiderlin

Published

on

Former Manchester United holding midfielder, Morgan Schneiderlin don come outside with regret for him eyes dey shalaye say if to say him know say him career go die for Old Trafford, him for no join United.

Before Manchester United buy am from Southampton, Schneiderlin na one of the hottest and no-nonsense defensive midfielders for Premier League. The boy good sotay United splash £31.5 million take sign am for 2015 to solve their midfield problem.

The guy join United thinking say him don finally arrive and from there, him go become superstar like Scholes or even Casemiro. Unfortunately for am, him and oga Luis Van Gaal be like Sanwo-Olu and Gbadebo wey no dey see eye to eye.

Morgan Schneiderlin currently dey play for Australia league

Their beef continue until Schneiderlin provoke leave United go join Everton after just 18 months. Na from there the bobo career begin fall like Naira wey no get control. Now, Morgan Schneiderlin wey dey play for Australia league don dey regret the day wey him agent convince am to sign for United:

”When I join United, my plan was to play there forever and become a legend for Old Trafford. But na after only 18 months I begin feel say I need to leave this club. The coachie no allow me play with freedom. I no fit express myself. And by the time I leave the club, I don forget myself.”

Schneiderlin say him try him best for Everton but by then it’s already too late because him don lose himself for Old Trafford. From Everton him decide to return home to France with OG Nice wey later send am on loan to Western Sydney FC inside Australia.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version