As e dey Hot

VAR official for Chelsea vs Tottenham match, Mike Dean no go officiate next round of EPL matches

Published

on

We don dey hear now say the VAR referee of dat Chelsea vs Tottenham match wey shele for Stamford Bridge on Sunday, oga Mike Dean, no go officiate VAR for the next round of matches wey go shele next weekend.

Although we dey suspect say e fit concern Wetin happen for dat match, we no get any confirmation say e get anything to do with the match. Una remember say plenty vawulence shele for dat match, both among players for pitch and coachies for touchline.

The vawulence strong sotay Chelsea coachie Thomas Tuchel and Tottenham coachie, Antonio Conte wan fight each other for pitch wey make referee nak dem two red card

The first vawulence shele when Tottenham equalise Chelsea first goal. Before the goal, one Tottenham player win the ball by using hard tackle take bring down Chelsea player. Chelsea players, dem coachie and dem fans believe say the ref suppose cancel the goal because of the rough tackle but him no cancel am.

The second vawulence shele when Tottenham equalise Chelsea second goal wey make the match end 2-2. Tottenham defender, Cristian Romero pull Chelsea defender, Marc Cucurella hair during the corner kick wey Harry Kane take score the equalizer. Yet the goal still stand.

Although the ref, oga Anthony Taylor no call all dis decisions, na wetin many people believe say VAR under the control of oga Mike Dean suppose check and make the right decision but instead VAR no check am. Na wetin make people dey suspect say na why oga Mike no go officiate next matches. Anthony Taylor on the other hand go officiate.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version