Wetin shele gan-gan

FA don open file for Thomas Tuchel head for saying Anthony Taylor do ojoro

Published

on

We don dey hear now say England FA don open file on top Chelsea coachie, oga Thomas Tuchel head unto some kind things wey him talk about the referee of Chelsea London derby match with Tottenham wey shele yesterday evening for Stamford Bridge.

Dat match tie wrapper sotay vawulence just dey fly helter-skelter. But inside the match wey end 2-2, many people including oga Tuchel no believe say any of Tottenham goals suppose be goal because Tottenham players play Chelsea players rough wey lead to those two goals.

Thomas Tuchel celebrate Chelsea second goal like craseman not knowing say for EPL, it is not over until it’s over

The tin pain Thomas Tuchel sotay by end of the match both him and Tottenham coachie, oga Antonio Conte don dey fight again for pitch wey make ref dash dem two red card. At dat time Tuchel think say the red card mean say him no go coach Chelsea for dem next match against Leeds but we find out say no be automatic suspension e be.

But even then, na dat provocation naim Thomas Tuchel take begin blast the ref, oga Anthony Taylor say: nna your ojoro too much abeg. In fact since I begin coach football, the kind ojoro wey you show me, I never see am before. Abeg as from today make you never officiate any Chelsea match again because we no fit dey play against 12 players for pitch including referee.

Na dat accusation of ojoro naim make FA don open file for Thomas Tuchel head so. According to the FA, dem go clean dem eyes and ears well take watch the video and listen to the audio well. Dem go also read the referee report well and if dem get any reason to believe say Tuchel talk pass him mouth, then him go get case to answer.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version