As e dey Go

EPL refs Kevin Friend, Martin Atkinson, Mike Dean and Jon Moss don retire from officiating

Published

on

We don dey hear now say EPL referee, oga Kevin Friend don retire from officiating. Oga Friend go join other EPL referees like Mike Dean, Martin Atkinson and Jon Moss wey don also retire as season don end so and na diswan don make EPL oga dem begin worry say all of the experienced referees wey dey EPL don retire finish and na small small boys wey fit be the same age with some of the players naim go dey officiate. How all dis Soro-soke generation players wan take respect dem now?

Kevin Friend wey dey 50 years old now start to dey ref match when him dey just 14 years. Seriously o. At dat age the bobo dey officiate match wey senior men dem dey play inside local league for Leicestershire inside Leicester. But not until 2009 when him dey 38 years naim him officiate him first ever EPL match when Wolves kpokpo Fulham 2-1. That same 2009 naim Kevin Friend nak him first red card to Sunderland skippo then, Lorik Cana.

Kevin Friend na no-nonsense referee wey no get time for too many shalaye. Although him name na Friend, when match start the man no dey friendly on top pitch because any player wey do anyhow go subscribe. The bobo don distribute 11 yellow cards plus 1 red card for one match wey him officiate for 2010. The bobo even use anger take nak Wes Brown red card for 2013 although FA later cancel am say the tin wey Brown do no warrant red card. Everybody know the bobo tape sotay dat season wey Leicester win EPL, Tottenham wey also dey challenge for the title no gree make him officiate dem match because him be Leicester fan and e fit go use mistake nak Tottenham red card.

Mike Dean na one of those EPL refs wey go don chop swear wotorwotor

Nobody know exactly why these 4 referees; Friend, Atkinson, Jon Moss and Mike Dean wan retire at the same time especially since na dem be the most experienced refs for the league today. We sha know say players and fans sabi swear for dem well well and we all know say all those swear no good to collect too much especially as pesin dey approach old age. Referee like Martin Atkinson, once Arsenal fans see him name as ref, swear don start even before match start. What about Jon Moss wey teach James Milner for secondary school but when Milner become professional footballer and Jon Moss catch am for pitch, the ref no hesitate to show Milner straight red card. Imagine make your secondary school teacher turn to village people on top your matter, shay you no go nak am better swear?

As for Mike Dean, I no even know where to start from. The guy no dey officiate match wey Liverpool lose because e be like him be secretly Liverpool fan and him village na the next village after Liverpool. Therefore, when the bobo wan officiate 2006 FA Cup final between Liverpool and West Ham, West Ham no gree make him officiate. Even for Wales, fans of Cardiff no like Mike Dean sotay during one match between Cardiff and Swansea, one Cardiff fan throw coins take burs the ref head. But na Arsenal fans still collect pass for the bobo hand after dem lose League Cup final against Birmingham wey him officiate before losing to Chelsea wey Mike Dean nak Arsenal defender Gabriel red card. Na da wan make Arsenal fans open petition for the guy head and over 100,000 fans sign the tin in less than 1 week.

Anyway, we wish the referees all the best for dem future endeavors.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version