As e dey Hot

FA dey investigate Arsenal for excessive celebration against Bournemouth

Published

on

As Arsenal dey hustle to win dem first Premier League title in nearly 20 years, e be like say dem no even fit celebrate winning match without getting into trouble as FA don open investigation for their head after dem come from 2 goals down to win Bournemouth 3-2 on Saturday.

Arsenal concede the second-fastest goal in EPL history when Naija blood, Philip Anyanwu Billing score for Bournemouth just 9 seconds after match start. The club wey dey 19th for EPL table continue dey press Arsenal neck when Marcos Senesi use one powerful header make am 2-0 for second half.

But Arsenal begin show championship spirit when Thomas Partey fire in the first goal from close range before Ben White equalise with another powerful rifle.

But na Reiss Nelson last-minute winner naim scatter everywhere as the substitute use one left foot shot take tear Bournemouth net and complete the comeback.

Na Reiss Nelson last minute winner scatter everywhere

As Nelson score the goal naim Emirates scatter sotay substitutes, fans and even some coaching officials run enter pitch to celebrate with the boys. And na dat celebration naim FA carry for mind so especially the coaching staff them.

According to FA rules, coachies and players wey dey for the technical area must behave responsibly at all times. So even if players and fans dey misbehave and do anyhow, them expect the coaching crew to act like senior men and no join them for the misbehaving.

Although Mikel Arteta no join them celebrate enter pitch, some Arsenal coachies and substitutes rush enter pitch go celebrate that goal when match clearly never end. Na wetin FA dey investigate be that and any player or coachie wey them find guilty fit pay up to £8,000 as fine.

Una remember say for January when Arsenal beat Manchester United 3-2, Uganda police arrest 20 Arsenal fans for celebrating like say them win league. Although them later release them, Arsenal fans feel say people just dey target them unnecessarily.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version