As e dey Go

Thomas Partey no dey Casemiro level – Rio Ferdinand

Published

on

As Arsenal dey warm up to jam Manchester United for Premier League on Sunday, United legend, Rio Ferdinand don come outside dey yan say, Thomas Partey good o, but right now him no dey Casemiro level because the Brazilian dey ahead of am.

Thomas Partey na one of the big egunu wey  dey push Arsenal dey perform the kind wonders wey them dey perform now. Mikel Arteta boys currently balance on top of the league table after winning 15 and losing just 1 of them 18 matches so far. But the only club wey beat them Na Manchester United.

United on their own part don pick form like danfo wey them push and start. Erik Ten Hag boys don win them last five league matches since losing 3-1 to Aston Villa for November. And Casemiro na one of the best players wey dey that team right now.

Manchester United na the only club to beat Arsenal for league this season

And Rio Ferdinand believe say the former Real Madrid midfield jagaban dey levels above him opposite number for Arsenal. According to Rio Ferdinand:

”Don’t get me wrong o. Partey good o. Maybe him even sabi distribute ball pass Casemiro. But as a defensive midfielder, Partey no even near him level. In fact Partey dey learn work where Casemiro dey because the kind work wey Casemiro dey work for United midfield, forget it, dem no born Partey well.”

According to statistics, Casemiro don win 46 tackles while Partey get 34. But Partey don win possession 116 times while Casemiro get 88. Casemiro don create 14 chances while Partey don create 13. But Partey get higher passing accuracy and higher progressive passes.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version