As e dey Hot

Arteta don promise Arsenal fans say Jorginho no go flop for Emirates

Published

on

After Arsenal sign Jorginho from Chelsea on transfer deadline day wey many Arsenal fans don dey shake head dey frown say them no too trust that signing, Arsenal coachie, oga Mikel Arteta don dey promise them say the former Chelsea assistant skippo no go flop.

Na injury wey go hook Mohamed Elneny plus Thomas Partey wey get small issue wey require scanning naim make Arsenal begin hunt for replacement. And after them spend the whole transfer window dey pursue Moises Caicedo for Brighton tire, even offer to pay £70m yet e no work, Arteta kuku face elsewhere.

And that elsewhere wey him face na the direction of Jorginho and in less than 24 hours, Arsenal don pay £10m pounds for the 31 years old player. But yet many Arsenal fans no too gbadun the deal because former Chelsea players like Willian and Gallas etc dey always flop for Arsenal.

The trophies and awards wey Jorginho don win Na only dream many Arsenal players dey dream of am

Na wetin make oga Arteta don come outside now dey tell them say make their mind rest say Jorginho story go different. According to Arteta:

”I understand una fears because pesin wey bee don bite before go dey fear housefly. Whenever club sign new player, nobody fit tell for sure whether him go shine or him go flop. But you see this Jorginho own, e sure me die say the bobo no go flop.”

Arsenal currently dey top Premier League table as them dey try to win their first title in 19 years. And Jorginho wey don win UCL, Europa, even win European Best Player award, the bobo pack experience wey Arsenal fit need to help them reach promised land.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version