As e dey Hot

United female fans dey plan protest against Mason Greenwood returning

Published

on

Greenwood must go

Manchester United women fans don dey plan to protest against Mason Greenwood returning to play for the first team. According to the fans, dem no expect the club to fall hand carry Greenwood back to the club sey dem expect the club to do the right thing.

Una remember say police arrest Mason Greenwood for January 2022 after him girlfriend post video of the beating wey Greenwood give am and audio wey carry Greenwood voice where him dey try rape her. As at that time, dem accuse am of wetin oyinbo dey call coercive behavior and attempted rape.

But for February this year, the Crown Prosecution Service for Manchester drop all cases against Greenwood onto sey all the witnesses for the case withdraw and dem come discover new evidence wey make dem nor fit continue the case.

Immediately dem announce sey Greenwood nor go court again, United announce sey dem dey do their own investigation into wetin shele gan-gan. Till now, dem nor va finish the investigation.

Now, even as court don free Greenwood, the female fans for United wan protest before Man U opening match for Premier League on Monday against Wolves. And these women don dey warn United say:

‘Nah now we go know the kind club wey Manchester United be. Nah now we go know weda dem support vawulence against women. If Greenwood come back to the club to play for our club, we nor go dey happy because we nor expect our club to dey support bad thing. We expect dem to do the right thing’.

As the Man U internal investigation for Greenwood matter still dey go on, we nor come know wetin dem go finally decide to do with the bobo.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version