Wetin shele gan-gan

Jay Z wey be correct Arsenal fan wan buy Tottenham

Published

on

Rap legend, Jay Z wey football world know sey nah correct Arsenal fan fit buy Tottenham Hotspur. People come dey wonder how person wey sey him be Arsenal fan go wan buy Tottenham wen him know sey Arsenal and Tottenham fans dem nor dey see eye to eye.

Forbes Magazine wey dey check how much big big men like Jay Z get sey him worth nearly $2b. Wen we check with aboki, the money amount to ₦1,584,008,504,000.00.  This one mean sey Jay Z get the money true true to buy club like Tottenham especially as the majority shareholder, Joe Lewis  for Tottenham get serious police case for US.

Joe Lewis don surrender himself to police and don sey him nor dey guilty for court after dem sey him dey do some kind backyard runs wey Oyinbo people dey call insider share dealing. Dem sey if dem do their investigation finish come find am guilty sey him fit dey for prison till thy kingdom come. Lewis company wey dem dey call ENIIC group get 86.8 percent of the club with Daniel Levi.

Jay Z bin wan invest for Arsenal for 2005 but e nor work out. Him bin get stake with NBA big shoe, Brooklyn Nets but for 2013, him open sports company Roc Nation to dey manage players. Kelvin de Bryune and Romelu Lukaku nah two of the biggest football stars wey him company dey manage.

So therefore, Jay Z dey arrange money for Ghana-must-go to come buy Tottenham in case Joe Lewis wey be their majority shareholder later enter kirikiri.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version