Wetin shele gan-gan

Arsenal kpokpo Barcelona 5-3 for dem last US preseason friendly

Published

on

Arsenal don kpokpo Barcelona 5-3 for dem last pre-season match of dem tour inside USA. Although dem call am friendly match, the players use red eyes take enter pitch wey make dem play the match like say na UCL final.

Na Barcelona first find trouble inside the seventh minute wey Robert Lewandowski use early rebound goal take give dem 1-0 lead. But Bukayo Saka show dem say no be who first call police dey win case after the Arsenal Number 7 equalize from close range to make am 1-1 after 13 minutes.

Saka show once again say him no be dependable penarity taker when him miss penarity wey Arsenal for take go ahead and Raphinha punish Arsenal with one deflected free kick to make am 2-1 for Barcelona.

But once again Arsenal equalize through Kai Havertz wey tap into empty net to make am 2-2 and make sure say first half end draw with both clubs scoring half of the full 8 goals inside first half.

Arsenal swear say dem no go go behind again for second half and na Leandro Trossard help dem keep dat promise with two back to back goals goals to make am 4-2 for The Gunners.

Na Trossard win Man if the Match

Barcelona reply with 88th minute goal from Ferran Torres only for Fabio Viera to score one beautiful outside canon one minute later to restore Arsenal full 2 goals lead and end the match 5-3.

Declan Rice no play the match because of one small knock wey him collect wey make many people begin wonder weda the 105 million signing dey blend well for the club seeing as dem play igbakugba take lose against United for the last match him play while diswan him no play, the team blend well.

With dis win, Arsenal go end dem American preseason tour in good form ahead of dem Charity Shield match with Manchester City to take declare the league season open.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version