As e dey Go

Man United and Chelsea no fit win league dis season, na City, Arsenal and Liverpool get am- McManaman

Published

on

Former Liverpool attacker, Steve McManaman don come outside with vawulence take dey tackle Manchester United and Chelsea say, if those two clubs dey dream of to win Premier League next season, make dem forget about am because dem no reach.

According to McManaman, inside Manchester City, Arsenal and Liverpool, na one of those 3 clubs get the Premier League because na dem 3 don show say dem get wetin e take.

Manchester United finish third last season, nearly 10 points behind Arsenal wey finish second. But so far apart from Andre Onana wey dem buy put for post, United never really enter market go buy attacking power wey dem need.

As for Chelsea, dem don try for transfer market with the signing of star players like Christopher Nkunku, Alex Matos, Nicholas Jackson and several others. Yet, many people no too rate dem new coachie, oga Mauricio Pochettino because him no sabi win major trophies.

Steve McManaman no believe say United and Chelsea go win dis league

But Manchester City na still the favorites to win the league again. Many people also believe say as Arsenal don sign Declan Rice and Kai Havertz so, dem go also give City serious run for the title again. But as for Liverpool, na injury be dem biggest problem. And according to McManaman:

Make Manchester United and Chelsea comot body because next season no be for dem. Na Arsenal and City go still run am again. As for Liverpool, we go dey pray make injury no use dem eyes take see shege because players like Luis Díaz and Diogo Jota suffer plenty injury last season wey affect dem.

The next Premier League season go start on August 11/12. Na then we go know whether Steve McManaman know wetin him dey talk abi him just dey yan dust.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version