As e dey Go

After 7 years inside wilderness Top 4 na the best trophy for Arsenal – Guardiola

Published

on

Manchester City coachie, oga Pep Guardiola don come outside dey console Arsenal fans say make dem no too reason am say dem club don lose dis Premier League title because after 7 barrens years, to qualify for Champions League na the best trophy wey dem fit win.

Arsenal don dey top the table since when league start till towards the end when e just be like say village people finally open their pot with just 10 games to go wey make dem begin off and on anyhow like Nepa.

First dem squander 2-0 lead allow Liverpool equalise 2-2 for Anfield. Na the same thing happen again for when dem visit West Ham as dem squander 2-0 lead against West Ham allow dem return back draw 2-2.

Just as the fans dey reason say make dem try beat those ones since na away games, the one wey worse pass come happen for Emirates as dem allow Southampton wey dey fight relegation to score 2-0, equalise 2-2, allow Soumptom score 3-2 before finally drawing the match 3-3.

Na Arsenal be their own problem as them don squander all dem opportunity to win the league

But the most painful one na when dem travel go Etihad to go jam Manchester City for wetin many people believe say go be title decider, only for City to completely destroy Arsenal 4-1.

With 2 matches outstanding for Man City and just 2 points behind Arsenal, many fans believe say the boys don fock up. Na diswan make oga Guardiola come outside dey encourage dem say no be so, after all, to finish Top 4 na trophy, according to Arsene Wenger.

”Many Gunners dey provoke say the season don worwor unto say dem lose Premier League title but if you check am, this season na big success for the club because after 7 years, dem don finally qualify to chill with the big boys for Champions League. Na the most important trophy for them be dat.”

Guardiola say with dis Top 4 finish, the best players go wan join Arsenal, people wey wan sponsor go pay more money, TV rights money go enter, the club go dey move ahead. And right now, all that one don sure for the club so the season no bad after all.

Manchester City go return back to the top of the league if dem beat West Ham for their match tonight.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version