As e dey Go

‘No coach big pass sack letter, not even me’- Pep Guardiola

Published

on

Manchester City coachie, oga Pep Guardiola don come outside dey draw ear give him fellow coachies dem say, una see dis Premier League wey we dey so, no single coachie big pass sacking because anybody wey no perform go collect.

This na lesson wey former Chelsea coachie, Graham Potter learn in a very harsh way after the club finally tire for the igbakugba wey him dey play despite the squad wey him carry wey make dem nak am immediate sack letter.

12 coaches don chop sacking this season for Premier League alone, the highest of any season in history. Chelsea account for 2 of those sacking, including the sack of Thomas Tuchel and now Graham Potter.

Southampton also account for 2 with the sacking of Ralph Hasenhuttl and Nathan Jones. Leicester also sack Brandon Rodgers, Bournemouth sack Scott Parker, Leeds sack Jesse Marsch, Crystal Palace sack Patrick Vieira, and Tottenham sack Antonio Conte.

Graham Potter sacking make am the 12th coachie to collect sack letter dis season

Other coachies wey chop sack include Frank Lampard from Everton, Steven Gerrard from Aston Villa and Bruno Lage from Wolves. Na diswan don make Pep Guardiola come outside dey shalaye say for dis EPL, nobody big pass ‘we regret to inform you that…’

”When I first come England, during the days of Sir Alex and Professor Wenger dem, coachies dey last for their job. But now money don spoil everything. New club owners don invest too much money and dem want immediate return. So as a coachie, if you no deliver, see you see sack letter.”

Guardiola also confess say the reason why him never chop sack letter anywhere for him career na because him know how to win matches and trophies. But the day wey him stop to deliver, him self go collect as e dey hot.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version