As e dey Hot

Manchester City fit lose points like Juventus for breaking EPL financial rules

Published

on

No be small sontin dey shele as we don dey hear now say Manchester City fit suffer points deduction after Premier League oga sue them to court for breaking the financial rules of the league.

If una remember well, similar something happen to Juventus recently after court find them guilty of breaching financial rules wey make Italian Football Federation deduct 15 points from them. That deduction move them from 3rd to 10th on top Serie A table.

For this Manchester City matter, na Premier League gan-gan dey accuse the club of financial wuruwuru. According to the oga them, na since 2009 this wuruwuru start and by 2018 wey the thing end, City don commit too many financial mago-mago sotay Premier League don decide to involve EFCC for the matter.

According to the tory, Manchester City dey give fake information about the money wey them dey make and the money wey them dey spend, and fake information about how much them dey pay players and coachies wey make us begin wonder whether them get ghost workers.

Similar thing happen to Juventus wey make them collect 10 points deduction

Them also dey give fake information about Uefa financial fair play rules and on top of that, them give fake information on whether the club dey even make gain as a business abi them just be like NNPC wey no dey make money but na them spend money pass.

Na all this questions naim Premier League oga them want make Manchester City come answer and them don refer the case to independent commission so that nobody go say ojoro involve for the outcome.

If the commission find Manchester City guilty, them fit deduct points from them for league table just like Juventus. Them even fit decide to relegate the Manchester club to Championship as punishment. City currently dey 2nd for EPL table and them dey hope to overtake Arsenal wey dey 5 points ahead.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version