As e dey Go

E pain me say Chelsea sack Graham Potter – Chelsea women coachie

Published

on

As Chelsea oga dem don finally give up and sack their coachie, oga Graham Potter, Chelsea women coachie, Emma Hayes don come outside dey shake head say as them sack the man so she no like am at all.

Na the start of this season wey Chelsea new owner, Todd Boehly sack former coachie, oga Thomas Tuchel naim them employ Graham Potter to come take over. Although the former Brighton coachie start well, things eventually no work out well for am.

The club spend nearly £700 million on top plenty new young players to make sure say Potter get the most expensive squad for Premier League. In fact, for the last transfer window, Chelsea alone spend money pass Serie A, Bundesliga, Ligue 1 and La Liga join together.

Players like Nonny Madueke, Mykhailo Mudryk, Benoit Badiashile, Joao Felix, Zakaria, Enzo Fernandes and David Datro Fofana all join the club for January transfer window.

But despite all this expenses, Chelsea under Potter still dey struggle to score goals, talk less of to winning matches. The team don win only 4 of their last 19 league matches. On top of that, them dey play igbakugba brand of football wey no get pattern at all.

The last straw wey break camel back na them last match wey Aston Villa beat them 2-0 for Stamford Bridge on Saturday. Although the club been dey back am say him go stay till the end of the season, the poor results don too much so them kuku sack am on Sunday.

Chelsea woman coachie say she no like wetin dem do Potter

Na this one don make Madam Hayes wey her babes do wetin the guys no fit do by beating Aston Villa babes 3-0, come outside dey para say this thing wey them do Graham Potter, she no like am at all. According to her:

“This thing pain me well well because I never expected it. I dey disappointed say them sack the guy but then na who get club go talk how e wan run the club so if oga Boehly say na to sack Potter be the best, no wahala. But personally for me, e no make sense at all.”

Chelsea don dey consider new managers wey them fit hire to replace Potter and some of the names wey dey on board na former Bayern Munich coachie, Julian Nagelsmann and former Barcelona and Spain coachie, Luis Enrique.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version