As e dey Go

6-1 wotorwotor: Tottenham players suppose refund fans money- Tottenham legend

Published

on

After that disgraceful 6-1 kponking wey Tottenham chop away for Newcastle home on Sunday, one of their legend, oga Chris Waddle don come outside with anger dey blast the players say dem suppose refund travelling fans dem money after that igbakugba wey dem play.

Na on Sunday naim Tottenham visit St James Park to play Newcastle for Premier League. As na 3 points separate both clubs for 4th and 5th, both clubs dey hustle for the last UCL spot. Therefore, many fans dey expect the match to hot pass fire.

Unfortunately, match never start before Newcastle don run score the first goal. Just when we think say Tottenham go fight back, Newcastle don bang another goal o. By 10 minutes into the match Newcastle dey win 3-0. By the 21st minute scores na 5-0.

Newcastle put am for Tottenham body wotorwotor

Tottenham manage pull one goal back for second half but Newcastle score another one to make sure say their 5-goals lead remain intact. Na this worwor score line don make this legend provoke come outside dey ask the players to refund fans dem money with immediate alacrity.

”Imagine our fans travel 600 miles just to go watch their team chop 6-1 gbenshing. O wrong nau. The players need to refund all the fans wey travel all their money back. From transport to hotel, even plus feeding and beer money, everything.”

Oga Waddle also blast the players say wetin former coachie, Antonio Conte talk about dem na true because dem no get any single bite or fight and dem na sabi handle pressure. Once dem see small pressure laidis, dem go collapse.

Tottenham next match na against another Top 4 contender, Manchester United and if dem no take time, dem go collect wotorwotor beating again.

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version