As e dey Go

‘Football belong to the people’- Bayern fans ask Man City and United owners to getat

Published

on

Bayern Munich fans pack demsef come visit Manchester City for Etihad last night as both clubs clash for the quarter final of Champions League. And the fans really ready come because during the match naim dem unfold one banner wey the home fans no go like.

Wetin dem write for the banner wey the Bayern fans unfold just after second half resume na make both the Glazers wey get Manchester United o, and Sheikh Mansour wey get City, make all of dem getat because football belong to the people.

This message provoke Manchester City fans sotay dem begin chant dem owner name in support of the man. The thing be like e provoke City players too because dem dey lead 1-0 when Bayern Munich fans open the banner but a few minutes later, dem don score 2 more to make am 3-0.

Yet the message show the difference between club ownership for England vs for Germany. For England the thing don turn to business finish with the likes of Kroenke, Fenway, Boehly and Saudi Consortium owning Arsenal, Liverpool, Chelsea and Newcastle.

The 50+1 rule for Bundesliga na very big deal wey fans no dey joke with

But for Germany, no single man or family dey own or control club. There, dem get wetin dem dey call the 50+1 rule which means say a club and the fans go always get 50% of shares of the club plus extra 1% wey go give dem controlling power.

Therefore, any other investors go dey hustle for the remaining 49%. So because of dis, clubs dey see fans as fans, unlike for England wey dem dey see fans as customers. Which is why England fans dey pay so much for ticket while German fans dey pay so little.

But all that one no concern England fans as long as their clubs dey beat the Bundesliga clubs on top dem rules. Who 50+1 help when Manchester City just nak your club 3-0?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version