As e dey Go

Chelsea don sack father and son wey don dey cut Stamford Bridge grass for 30 years

Published

on

As everything wey dey happen for Chelsea continue to dey happen, we don dey hear now say the club don sack the man wey dey take care of them grass, oga Jason Griffin, and him son, Reisse Griffin from the club.

Na since 2003 naim Griffin don join Chelsea as them chief groundsman. That mean say na him dey take care of the grass for them stadium, Stamford Bridge, them training ground, Cobham, and for Kingsmeadow where them women and academy dey play.

Na more than 10 years ago naim oga Jason Griffin carry him pikin join body to come become him assistant and since then, the father and son don dey cut Chelsea grass, dey water am and make sure say the grass is always green.

Todd Boehly just dey sack people anyhow like all dis China factory

But now, Chelsea don sack the two of them and nobody even know the reason why. Everybody don ask Chelsea why them remove food from the family table like this but nobody dey answer.

Na since Todd Boehly buy the club naim the man don dey sack people left right and centre. Baba start by sacking former Chelsea coachie, oga Thomas Tuchel. Since then Boehly don sack players, medical staff, interns, toilet cleaners and now, father and son grass cutters.

Despite all of this, Chelsea never still fit climb above 10th position for Premier League table wey make many people dey wonder say since oga Boehly like to sack people so much, why him never sack Graham Potter wey never fit move the club to permanent site.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version