As e dey Go

Fans vote Kevin de Bruyne as best midfielder in Premier League history

Published

on

We don dey hear now say some fans don go online to vote for the best Premier League midfielder of all time. And out of all the midfielders wey dey the ballot, na Kevin de Bruyne of Manchester City the fans vote as the best in history.

Na one football data company wey dem dey call Visual Game naim be the INEC wey conduct dat election. And some of the legendary Premier League midfielders wey feature for dat election na Paul Scholes, Patrick Vieira, Frank Lampard, Roy Keane etc.

But after dem upload the votes enter IRev wey dem announce the results, we see am say na Kevin de Bruyne win the election to become the best midfielder to ever play for EPL. Na Steven Gerrard of Liverpool come second while Frank Lampard of Chelsea come third.

Na Steven Gerrard carry second

Manchester United legend, Paul Scholes come fourth while Arsenal legend and former Crystal Palace coachie, Patrick Vieira complete the Top 5. Out of all the Top 10, na only De Bruyne and Ngolo Kante of Chelsea wey finish 10th still dey play active football.

Kevin de Bruyne na two-time PFA Player of the Year. The Manchester City midfield maestro recently become the fastest player for history of EPL to hit 100 assists ahead of Cesc Fabregas wey hold the previous record.

Kevin de Bruyne currently dey try help Manchester City win UCL after their hooge 3-1 home win for dem quarter final first leg. Him dey also try help him club come from behind overtake Arsenal to win Premier League for the third consecutive season.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version