As e dey Go

‘Barcelona no disgrace Real Madrid, na just normal beating dem beat us’ – Ancelotti

Published

on

After Barcelona kpokpo Real Madrid 3-1 to win the Spanish Super Cup, and after many people don dey call am ‘humiliation’ and ‘disgrace’, Madrid coachie, oga Carlo Ancelotti don come outside dey shalaye say that win no be any humiliation or disgrace.

According to the coachie: when we beat Barcelona 3-1 for league why them no call am disgrace? Now Barca don beat us the same 3-1 back and people dey call am disgrace. Abeg make una no dey cap anyhow because that capping na disrespect to my club.

The Super Cup match really tie wrapper for Real Madrid as Barcelona just dey rush them dey give them fire for fire until Gavi wey be the star man of the night score the opening goal for Barcelona.

The same Gavi wey dey 18 years old set up Lewandowski for the second goal to end first half 2-0, before setting up Pedri to make am 3-0 inside second half. Karim Benzema score late goal for Real Madrid but na only consolation goal e be.

Barcelona kpokpo Real Madrid 3-1 to win the Spanish Super Cup

That loss to Barcelona for the Super Cup make am the second match wey Real Madrid go lose in a week after losing to Villarreal for La Liga shortly before them travel go Saudi Arabia where them play the Spanish Super Cup. And na this litany of losses naim Carlo Ancelotti no like at all.

According to the UCL-winning coachie, Barcelona play better than him boys and combined with the errors wey him players just dey make, even the blind can see say Real Madrid no deserve to win the match:

“Na the mistakes wey we make naim kill us for the match. If you watch them first two goals na counter. As a team we get the right attitude but na individual mistakes naim decide the match. So make anybody no call am disgrace again.”

The Spanish Super Cup na the first trophy wey Barcelona dey win under Xavi, and then first trophy since Lionel Messi leave them go join PSG.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version