As e dey Go

GOAT vs GOAT: Ronaldo to face Messi for him first match for Saudi Arabia

Published

on

Following Cristiano Ronaldo move to Al Nassr inside Saudi Arabia, many football fans don dey wonder whether we go ever see him and Messi share the same pitch again. But e be like say that question don finally get answer as we don dey hear now say the 2 GOATS fit lock horns once again this January so.

This na because Ronaldo coachie for Al Nassr, oga Rudi Garcia don confirm say the star boy go follow play for the All-star friendly wey go shele between Saudi Arabia All-star team of Al Nassr and Al Hilal players vs PSG.

Lionel Messi more or less hammer nail inside the coffin of the GOAT matter when him carry Argentina win Qatar 2022 World Cup. The PSG talisman also win the best player of the tournament after winning the highest assist and the second highest goal scorer behind him PSG teammate, Kylian Mbappe.

Ronaldo no perform for World Cup but him end the year with joy after landing the biggest deal in football history

Ronaldo no perform for World Cup at all but immediately after the competition naim the Real Madrid legend wey just separate from Manchester United land himself the biggest deal in football history. The Portugal skippo go join Al Nassr on top £175m a year deal wey make am the highest paid footballer if all-time.

But that move carry am far from Europe and far from Messi. Cristiano Ronaldo still never play him first match for him new club because of 2-match ban wey him carryover from EPL. But right now him first match for Saudi Arabia fit be against him longtime nemesis, Messi.

The match go hold on January 19 and according to wetin we hear, the ticket for the match don already sold out. Al Nassr don gain 10 million new followers for Instagram since Ronaldo join the club.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version