Connect with us

As e dey Go

Transfer News: Liverpool don agree to sign €100m Darwin Nunez, PSG don ready to sack Pochettino

Published

on

Transfer news: Liverpool wan break kolo plus esusu take sign Darwin Nunez €100m

For our first transfer news today, we fit confirm give una say Liverpool don finally agree to count 100 million euros inside Ghana-must-go carry am go sign Darwin Nunez from Benfica straight to Anfield on top 5 years marriage contract. Na Benfica confirm the agreement for dem website and social media.

Liverpool go first pay bride price of 75 million euros for 22 years old Nunez and if e turn out to be better wife, Liverpool go pay extra 25 million as add one and other bonuses. Darwin Nunez wey from Uruguay score 34 goals on top four assists inside 41 matches for Benfica dis season. But na after him score both home and away when Liverpool jam dem for UCL naim Jurgen Klopp say mbanunu, we need to sign dis guy because the bobo na fire.

With player like Sadio Mane leaving the club, Klopp no wan waste time to begin replace the guy and give himself more attacking options. Some analysts don dey talk say make we forget Haaland because dis Darwin Nunez naim be the real egunu.

PSG don ready to sack Pochettino

We don dear don dey hear say Ligue 1 champions, PSG don finally ready to sack Mauricio Pochettino comot from the club after only 2 years for the club. According to wetin we hear, PSG don do small meeting umunna with the coachie on top the matter and everybody don agree say time don reach for Pochettino to move on because him no fit take PSG to the promised land.

Transfer News: Liverpool don agree to sign €100m Darwin Nunez, PSG don sack Pochettino

Mauricio Pochettino

Upon say PSG buy world best player, Lionel Messi join the stars wey full there already, still yet Pochettino no fit carry dem cross Round of 16 of UCL. But the bobo manage win him first trophy as a coachie for PSG and na diswan make many people dey wonder weda no be say the guy just use PSG take improve him CV yet him no fit give PSG wetin dem want in return.

We don dey hear say na either of Zinedine Zidane, Jose Mourinho and Nice coachie, oga Christophe Galtier naim PSG dey plan choose to replace Pochettino.

Everton don nak £50m for Richarlison head

Everton oga dem don come outside dey draw ear give anybody wey wan come to marry dem star player, Richarlison say, if you no hold more than 50 million pounds, my brother you better face your front because we no go answer you.

Richarlison ball well well for Everton wey help dem survive relegation sotay the bobo score 6 goals inside 9 matches during the struggle. Na diswan make Frank Lampard dey shake head say abeg make anybody no sell Richarlison go anywhere because dat boy na key player for him plan.

Transfer News: Liverpool don agree to sign €100m Darwin Nunez, PSG don sack Pochettino

Richarlison

Clubs like Real Madrid and PSG dey eye Richarlison but na Tottenham serious pass to marry the guy sotay dem don use UCL take dey toast am. But as you can see, Everton don tell dem say if dem no hold more than 50 million, make dem forget about the matter and since him contract remain 2 years, dem no dey in a hurry.

As e dey Go

I dey remind Victor Osimhen everyday to join Chelsea- John Obi Mikel

Published

on

Make Chelsea sack Pochettino if him no fit deliver the container- John Obi Mikel

Former Super Eagles skippo, John Obi Mikel don come outside dey shalaye say na almost everyday him dey chat Victor Osimhen dey remind am say make him no join any other club wey no be Chelsea because na club wey go favour am be that.

Osimhen wey be the current African footballer of the year dey currently play for Napoli but everybody believe say soon and very soon the Nigerian hit man go need to leave the club for something bigger.

And Mikel wey be former Chelsea player and legend after him carry them win Champions League believe say na him former club go fit Victor Osimhen pass. According to Mikel:

I know say many other clubs dey chook eyes for Osimhen matter. Clubs like PSG, Liverpool and even Manchester United dey toast am. But I believe say if you watch Chelsea now, our problem na say we no sabi put ball inside net. And the only work wey Osimhen sabi na to put ball into net. If that bobo come Chelsea, walai talai him go blow pass Timaya.

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award
Mikel Obi also say na him dey act as Victor Osimhen agent for this parol. Him say Osimhen fit no be the most flashy player wey too skillful. But just like Haaland, Osimhen sabi put ball inside net and na wetin make am be big player be that.

Victor Osimhen na sharp shooter wey score 26 goals take help Napoli win Italian Serie A for the 2022/23 season. So far, the 25 years old striker don score 13 goals inside 21 appearances for Napoli this season including the hat trick wey him score against Sassuolo for Napoli last Serie A match.

 

Continue Reading

As e dey Go

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Published

on

Transfer news: PSG wan sign Marcus Rashford, Manchester United don agree price with Rabiot

Premier League legend, Alan Shearer don come outside dey draw ear give Marcus Rashford take dey warn am say, if you no take time and begin behave yourself, you go waste this your talent and your career. This one na after Marcus Rashford miss Manchester United FA Cup 4-2 win against Newport on Sunday.

According to Manchester United manager, Erik Ten Hag, Rashford miss the match because him call in sick on the Friday before the match say him no go fit make am. But reports show say Rashford been go one night club on that Wednesday go over enjoy and na since after that club naim wetin dey do am begin do am. Ten Hag say na internal matter so him go deal with am internally.

But this one don make many people dey wonder say which kind internal issue go make player no even turn up on the day of match? Alan Shearer also recall sometime last season when the same Marcus Rashford chop punishment after him arrive late for meeting before one of them league matches.

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Alan Shearer

Na this one don make Shearer wey be Premier all-time top scorer de shake head with pity say Rashford just want to waste him talent. According to the legendary striker:

Marcus Rashford get big talent o, but the problem now be say him just want to waste am. Because we see the boy when him serious last season na. But this season so far, I no know wetin be him problem, whether him get family problem abi him girlfriend dey give am problem, or maybe na just village people, we need to help this boy and find out wetin be the problem otherwise him go just waste him career for nothing.

Alan Shearer also advice Rashford to find better manager and surround himself with wise people wey go dey remind am say if him continue like this and him career end, then him go truly regret him life and him wasted talent.

For now we dey wait to see how Erik Ten Hag wan take resolve Marcus Rashford internal problems.

Continue Reading

As e dey Go

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Published

on

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

As AFCON 2023 don enter knockout stage wey them don pair Nigeria to play Cameroon for the Round of 16 so, Super Eagles legend, Segun Odegbami don come outside like KingKong dey beat him chest say this Cameroon match go too easy for Nigeria because we go beat them like small pikin.

This one dey come after the AFCON wey dey happen inside Ivory Coast progress from the group stage enter knockout stages. This talk confuse many people because even for the group stage self, the Super Eagles no really impress as them manage to score only three goals in their three matches still finish second for the group.

On top of that the ball wey them dey play no even dey sweet for eyes make we say na that one we take hold body self. But on top of all of this, Mathematical Segun believe say Nigeria wey no dey give fans joy go easily beat and eliminate five-time AFCON champions, Cameroon from the competition.

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Segun Odegbami believe say Cameroon no be Nigeria mate

According to Odegbami:

Na this Cameroon wey everybody dey fear naim go be our easiest match for this AFCON. Because all those their gidigbo football wey them like to dey play no go work for this new stadium wey we dey go. The former stadium wey them been dey play rough like farmland. But na this smooth pitch naim we go catch them take show them correct pepper.

Segun Odegbami also talk say the Super Eagles dey improve for them game because after drawing their first match them win the last two. According to the legend, na progressive that so no shaking for that Round of 16 match.

Nigeria go play Cameroon for their Round of 16 match wey go happen on Saturday by 9pm Nigeria time. Wetin you think about that match? Abeg tell us for comment section.

Continue Reading

Trending