As e dey Go

Transfer news: Chelsea dey toast €150m Leao, Manchester United wan sign new keeper

Published

on

For transfer news dis morning, we don dey hear now say Chelsea don dey plan to sign Rafael Leao from AC Milan. Chelsea really need attacking players because to score don become big problem for dem. And after dem return Romelu Lukaku and Timo Werner back to where dem come from, none of dem front 3 don score dis season.

Rafael Leao na Portuguese attacker wey get both speed and power wey don make many people talk say EPL football fit favour am. The only problem for dis Leao transfer now be say the bobo contract carry release clause of 150 million euros and we never sure if Chelsea go gree pay da kind money. Chelsea also dey target former Arsenal striker, Pierre-Emerick Aubameyang.

Manchester United wan sign new Kevin Trapp

We don dey hear now say Manchester United don drop marriage proposal give Eintracht Frankfurt to take sign their keeper, Kevin Trapp comot from the club straight to Old Trafford. After the kind akpere performance wey De Gea perform against Brentford, maybe na da wan make the club begin reading new keeper so.

Kevin Trapp wey also be PSG Number 1 before, win Europa League with Frankfurt last season

Kevin Trapp na 32 years old experienced defender wey even follow Germany win FIFA Confederations Cup for 2017. But the former PSG keeper also win many local trophies for Ligue 1 before winning the biggest one last season when him save Aaron Ramsey penarity to help Frankfurt beat Rangers and win the Europa League. We never sure how much United dey price the guy sha.

Ziyech dey wait to join Ajax from Chelsea

We don dey hear now say Chelsea winger, Hakim Ziyech don dey warm up to return to him former club, Ajax, after two years wey him join Chelsea from the same Ajax. According to the tory, na since May naim Chelsea don dey find way to offload the guy and now e be like say e finally don wan happen.

Hakim Ziyech wan return back to Ajax

Na for 2020 naim Hakim Ziyech wey dey 29 years old join Chelsea from Ajax. Although him win UCL for him first season, e be like things no later go well between him and Thomas Tuchel wey make dem wan sell am now. Ajax jus dey wait now make Antony finally join Manchester United before dem go finally submit proposal to bring the bobo back to Eredivisie.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version