As e dey Go

‘No use money spoil the boys’ fans react as Ahmed Musa promise Golden Eaglets N500k per goal

Published

on

As Naija Golden Eaglets dey ready to take part in the AFCON U-17 championship, we don dey hear now say Super Eagles skippo, Ahmed Musa don promise to nak the team N500,000 cash for each and every goal wey dem score.

Musa surprise the boys when him turn up for Park View Hotel wey dem camp inside Abuja dey prepare for their competition. After encouraging the boys to maximize this stage of their football career, the Naija skippo finally scatter everywhere when him declare the money.

While many people dey hail Ahmed Musa for showing the Golden Eaglets love while also motivating them to try to play well, score goals and most importantly win the competition, many other people don dey shake head say wetin Musa do no make sense at all.

Musa visit the boys for dem camp inside Abuja

According to them, na promises like this naim dey make players enter pitch, leave wetin coachie tell them to play begin play igbakugba all because them wan score goal so that N500k go sure for dem.

According to one fan, Collins Ogugua: “Una don forget the last time wey dem promise the Super Eagles this kind money. Shebi na then confusion enter the team body sotay everybody including keeper wan score. In the end nobody score and Tunisia beat us jabo from the competition.”

Another fan, John Uwondo even draw ear give Musa say make him no even start this thing at all. The bobo say: “Oga Musa, make this behaviour end with una generation, make una no pass am down to this small boys. Because na so una carry money mentality go Cameroon for AFCON yet una return empty handed.”

Another fan, Jamiu Salaudeen say: “This thing wey Ahmed Musa do so na the wrong way of encouraging the boys. Next time keep your promise to yourself and after the tournament, bring the money come appreciate the boys instead. That way dem go understand say hard work dey come before reward.”

The U-17 AFCON go shele inside Algeria from April 29 to May 19. The Golden Eaglets dey Group B where dem go face South Africa, Morocco and Zambia for wetin many people dey call the Group of Death. The winners and two runners-up go qualify for the FIFA U-17 World Cup.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version