As e dey Go

32 Cameroon U-17 players fail age test wey Eto’o arrange for them

Published

on

My people e be like say age grade football no be anybody mate again as we don dey hear now say at least 32 Under-17 Cameroon national team players don fail MRI age test wey them arrange for them. This na players wey dey prepare to play the Central African qualifiers wey go start next week.

According to wetin we hear, na Samuel Eto’o wey be the oga kpatakpata of Cameroon football federation, Fecafoot, naim put the order down say every player wey dey that Under-17 camp must either take that age testing or forget about playing for the team.

Una know say this age cheating of a thing don become one of the biggest problems for African football. Even though FIFA don introduce MRI testing since 2009, yet many African countries no dey gree run the test for them age grade players.

Na Samuel Eto’o arrange the testing and anybody wey fail the test must leave the U-17 camp

But when Samuel Eto’o dey campaign to become the presido of Cameroon football, him promise say him go chook eyes for that testing and make sure say old men no dey disguise as teenagers come dey play age grade football. So na wetin Eto’o promise naim him dey do so.

According to the tory, out of the initial 30 players wey dey the Under-17 camp, 21 of them fail the MRI age testing wey make Eto’o pursue them comot from the camp. When the coachies enter street go hustle additional 11 new players to join the team, all those 11 players too fail the test.

Right now na only 9 players dey camp for Cameroon as them ready to take on Congo, Chad, DR Congo and Central African Republic for the Central African Football Federations’ Union (UNIFFAC) Under-17 AFCON qualifiers.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version