As e dey Hot

Na Cameroon vs Morocco go play World Cup final – Samuel Eto’o

Published

on

African football legend and the president of Cameroon Football Federation, Samuel Eto’o don come outside dey tell everybody say, una see this 2022 World Cup wey go shele for Qatar so, African countries go shock the whole world.

According to Eto’o, na two African countries go play the final and those two African countries na Cameroon vs Morocco. In fact Samuel Eto’o even go further to announce say Cameroon go beat Morocco take win the whole competition.

Wetin Samuel Eto’o just yan so na wetin oyibo man dey call tall order and even many people go talk say for one African country play final to win this World Cup dey impossible, not to talk of 2 and then for one of them to win the competition.

Morocco national team

No African country don ever cross the quarter final enter semi final and na only 3 African countries don ever play for quarter final which is Cameroon wey first do am for Italy 1990, Senegal wey do am for Korea/Japan 2002, and Ghana wey do am last for South Africa 2010.

But now, Samuel Eto’o dey pick two African countries to not only cross the quarter final wey be them normal bus stop, but to also go all the way to the final and win the whole thing.

According to am, “previously, African players no dey get experience to win World Cup. But now, with so many African players playing for the top leagues for Europe and around the world, them don get the experience to play and to win am.”

Eto’o wey be one of the greatest footballers from Africa play this competition 4 times and even himself no reach quarter final. And now him don nominate Cameroon wey dey rank 35 for world and Morocco wey dey rank 22 to win am. My people how una see dis kind Samuel Eto’o prediction so?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version