As e dey Go

Josko Gvardiol condition Man City to play friendly match with Leipzig before him sign for dem

Published

on

Gvardiol dey do medicals for Manchester

We don dey hear now say RB Leipzig defender, Josko Gvardiol give Manchester City condition say dem must agree to play friendly match with Leipzig before him go agree to sign for dem. Na Christian Falk wey be ogbonga journalist for Germany naim confirm diswan.

The bobo sey the €90m wey Manchester City go pay RB Leipzig for their defender nor get additional money wey City go pay in future but sey City don kuku agree to play the friendly match in future with Leipzig. We hear sey all the money wey dem go make for that match go go directly to Leipzig.

This one dey happen as we fit confirm sey Gvardiol dey do him medical for Manchester today after City finally agree £77.8m for him head. The deal still nor reach the record for the defender wey cost pass. Manchester United sign Harry Maguire £80m from Leicester City and nah Maguire still hold the record. Falk sey:

‘I don always tell una sey Josko Gvardiol go join Manchester City. City bin price him market for January transfer window but Leipzig nor gree. But now, dem don agree to finally sell and dem dey get the money wey dem want. City nor go pay additional money in future but dem go play friendly match in future with Leipzig and all the money wey dem make for the friendly go go to Leipzig’.

As e be with most transfers wey dey shele for European football, e dey always get additional money wey clubs wey wan buy player go pay in future but the Gvardiol deal dey surprise many football people because e dey hardly happen sey buying club dey agree to play friendly match and dash their own share of the money wey dem suppose make for the friendly to the selling club.

City don already sell Riyahd Mahrez and lose Ikay Gundogan for free this transfer window. Even though Kyle Walker and Bernado Silva dey reason comot, City wan make sure sey dem sign better players wey go help dem win more trophies next season.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version