Wetin shele gan-gan

Manchester United don finally remove captain from Harry Maguire hand

Published

on

Manchester United don finally remove the captaincy from the hand of Harry Maguire after more than 3 years. Na Maguire himself confirm the tori for Twitter say him and United coachie, Erik Ten Hag naim agree after one small umunna meeting wey dem do on Sunday.

Although Harry Maguire say the thing pain am well well because he never hexperedit, the truth be say no big club want to get captain wey dey siddan for bench. Moreover with the kind calamity ball wey Maguire dey play the few times wey dem put am for ball, no club deserve captain wey no fit lead by example.

As e be so, nah Bruno Fernandes many people believe say na him go wear the armband since nah him wear am throughout last season anytime wey Maguire nor dey pitch which is most times.

Maguire sef don kuku agree to support the government of the next captain make e for no loss. According to am:

“I go like to use this chance to thank Ole Gurnar Solksjaer for making me captain when I first come this big club. I dey bugga anytime I wear the armband make I nor lie. I go like thank the fans for all their support and I go always do my best anytime wey I play and I go support the next captain.”

Harry Maguire no be United skippo again

This tori don make many football people dey think sey United wan sell Harry Maguire as West Ham don already dey prepare bride price to come do small thing for him head. In fact many United fans don even dey beg Ten Hag to sell the defender wey be one of the most expensive defenders when dem buy am, and use the money go sign correct striker like Victor Osimhen.

But United oga dem don dey play Maguire people dem sey dem nor wan pursue am comot for the club even though e get players wey dem wan sell to raise money to buy players. As e be so, we nor come know wetin go happen to Maguire as him case don dey resemble “is coming”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version