As e dey Hot

‘Sell Maguire, add money buy Osimhen’ – Manchester United fans to Ten Hag

Published

on

After Naija big striker, Victor Osimhen score one powerful goal take help Napoli destroy Roma for Serie A yesterday, Manchester United fans don come outside dey beg their coachie, oga Erik Ten Hag to make the Naija boy them priority market next season.

 

The Super Eagles striker use chest take control one long cross down inside Roma 18 yard box, set the ball with him knee before hammering one wucked half volley inside net for the first goal wey Napoli take beat Roma 2-1 and extend their lead on top Serie A table by 13 points.

But no be today Osimhen begin bang goals because since this season start naim the 24 years old boy don dey bang goals anyhow sotay na him be the current top scorer for the league with 14 goals.

United fans don dey beg Ten Hag to sell Maguire and use the money take buy Osimhen

Osimhen na currently one of the hottest strikers in the world and Manchester United fans don dey warn their coachie and sporting director them to sign the bobo sharply. According to one of the fans:

“Oga Ten Hag shay you dey watch wetin Osimhen dey perform for Napoli abi? Tomorrow if them say make you sign striker you go carry Weghorst come for us, instead of better striker wey dey tear net upandan.”

Another fan say if Ten Hag know wetin good for am make him sell Martial, sell Sancho, sell Elanga, even sell Maguire and join all the money together take go buy Victor Osimhen and see if him no go win UCL next season.

Manchester United don dey bounce back to their usual self under Erik Ten Hag. And with the signing of players like Eriksen, Antony, Martinez and Casemiro enter the team, their fans don begin believe again. And right now, them believe say the coachie need to bring Victor Osimhen to Old Trafford make everywhere jollof.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version