As e dey Go

If Chelsea like make dem finish 17th for table, I for still sign for dem -Christopher Nkunku

Published

on

Chelsea new signing, Christopher Nkunku don come outside dey beat him chest say as una see me so, I love Chelsea die because e no matter whether dem finish 10th or 20th, I don already make up my mind to join the club.

Nkunku wey Chelsea count £53 million take sign am from RB Leipzig believe say wetin happen to Chelsea last season no be normal something and say now wey him don land for Stamford Bridge so, everything go begin jollof for the club.

Last season na the absolute worst for Chelsea in recent times because for the first time in a long time, dem no qualify for any European competition. Not even Europa Conference League wey small small clubs like West Ham take dey mark register for Europe.

First off, UK government pursue their former owner, oga Roman Abramovic before forcing am to sell the club give American businessman, Todd Boehly. Boehly enter begin buy players anyhow like say na jankara market him dey.

Then the owner brutally sack the coachie then, oga Thomas Tuchel wey win UCL for the club, replace am with Graham Potter wey him highest achievement na to coach Brighton from mid table to mid table.

Chelsea sack Tuchel, replace am with Potter, con still sack the Potter join all in one season

As expected, Potter no fit meet up and the solution wey Boehly bring na to sign more young players with long term contracts. When e no change anything, Boehly kukuma vex sack Potter, replace am with Lampard wey dem just sack from Everton.

By the time this boju-boju story go end, Chelsea don manage finish 12th for Premier League table. But despite dat low position wey dem no even dey play for Europe at all, Christopher Nkunku still sign for dem. And now the bobo don the explain say e no matter wetin sup, na Chelsea him don choose to play for:

If Chelsea like make dem even finish for 16 or 17, to me e no matter. Everybody know say Chelsea fall hand last season. But last season na old story now. Next season naim be the koko. Na new chapter and new project. And na wetin make me sign for dem be that because I wan be a part of dis new story wey wan shele for Chelsea.

Immediately season end naim Chelsea rush go sign Mauricio Pochettino wey carry Tottenham reach UCL final to come be dem new coachie. Dem also sign new players like Nkunku, Nicholas Jackson etc to join the project. And now Nkunku believe say dem get squad wey good enough to return the club back to the top of English and European football.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version