As e dey Go

Manchester City dey make other clubs look like small pikin – Guimaraes

Published

on

Newcastle United midfield jagaban, Bruno Guimaraes, don come outside for market square dey confess give the whole public sey him hate to play against Manchester City because anytime wey you play against dem, dem go make you look like small Pikin wey still dey play Principals Cup.

Guimaraes sey the thing wey dey pain am pass be sey City dey make other teams be like say dem no complete come pitch especially for that their Itihad Stadium. e go come be like say na 15 against 10 City dey play dem.

Him sey anytime wey him go Itihad with Newcastle to play dem, e dey always happen sey dem dey score early goal against dem. Him sey everywhere go just blue blue like Baba Blue kingdom.

Manchester City na the best team for England by far

According to am, nor be juju sey City nah the best team for England  and sey no other team reach their level. Him sey e nor go easy for other teams to challenge City but sey dem go try as e be sey nah by faith dem dey use move mountain.

Newcastle United carry 4th last season for English Premier League after dem troway  Liverpool, Chelsea and Spurs go one corner. Wen the season start, nobody believe sey Newcastle go even dey top 10. But dem show football world sey football dey beautiful cos anybody fit rise at anytime. As e be so, nah Newcastle example motivational speakers dem don dey use sell their market.

Guimaraes dey hope sey him team go achieve more and win something  next season even though dem qualify for Champions League this season for the first time in  20 years. Dem qualify for their first final after 24 years last season and dem never win even charcoal for the past 54 years.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version