As e dey Go

If La Liga cheap, oya enter Oyingbo market go buy am- Xavi

Published

on

After one TV presenter open mouth wey him take dey chop cocoyam take talk say this La Liga wey Barcelona wan win so na the cheapest in recent years, oga Xavi Hernandez don come outside dey tackle the presenter say if the thing cheap, make him enter market go buy am.

Barcelona dey lead La Liga table with 13 points and even though mathematically dem never win am, nobody expect dem to lose the league title from here. But despite their dominance for Spain, if you enter Europe the club dey play like say dem dey learn work there.

Barcelona first jabo from the group stage of the Champions League after winning only 2 matches. And when dem enter Europa wey many people think say dem fit go far small, Manchester United beat dem comot for their play off match.

E no end there as Real Madrid also beat dem jabo from Copa del Rey. Na diswan don make many people dey believe say even this La Liga wey Barca wan win na fluke wey just dey happen because other teams no dey organized.

Barcelona don jabo from Europe as well as Copa del Rey

Na wetin make that reporter open mouth talk say the La Liga cheap because Barca wey don concede only 9 goals for league dis season, get am easy. But Xavi Hernandez no ready to accept da kind nonsense downgrading and him don come outside dey yan say:

”If I tell you say da nonsense talk no pain me enter my bone, na lie. For the first time since Messi leave, we wan win La Liga. All the sacrifice, sweat and blood wey the boys don shed to achieve this result, yet somebody wey never do warm up for him life dey call am cheap. If e cheap Oya enter market go buy am na.”

Xavi also talk say if dem win the league, him and him boys go celebrate big time like say dem win World Cup. Because even though some people dey try downplay the thing, the fact remains that to win the league na very big deal.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version