As e dey Hot

New year, new Vawulence: Vinicius Junior blast La Liga say na dem dey encourage racism

Published

on

Real Madrid attacker, Vinicius Junior don come outside dey point finger inside the eyes of La Liga oga them say you see all this racism wey still dey happen for the league, na them dey cause am because them no dey fight the racism at all.

Una remember say Real Madrid score 2 late goals take beat Real Valladolid 2-0 away win on Friday. And na during that match naim Valladolid fans begin use racism chants take dey abuse Vinicius Junior.

The fans call am black monkey. Them call am black devil. Them call am black charcoal. Them even call am Black Maria, monkey banana, black gorilla, Noob Saibot, and every other kind of black racist name wey them fit think of. When that one no do them, them begin stone am pure water, rotten orange and plastic.

Na this one make Vinicius Junior don come outside with anger take dey chook hand inside the eyes of La Liga oga them say the only reason why all this racism something still dey happen na because them no dey do anything about am.

According to the Brazil World Cup star: Racists go continue dey pack them self come some of the biggest stadiums for Spain, dey shout racist abuse to some of the biggest footballers for the whole world, yet wetin La Liga dey do about am? Absolutely nothing.

Vini Junior say him go continue dey pepper racists with him talent and trophies

Vini Junior say all that one no concern am sha. If La Liga like make them no do anything and if the racists like make them continue dey shout monkey chants, him go just continue dey pepper them with him talent and trophies as a footballer because na the only language wey him sabi be that.

But the president of La Liga, oga Javier Tebas don come outside dey reply Vinicius say: haba mana! How you go open your mouth talk this kind thing? Me wey don dey fight racism for donkey years, am I a joke to you? Since I become presido nothing I fight pass racism and for you to claim say we no dey do anything na balablu, blublu and bulaba you dey talk so.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version