As e dey Hot

Real Madrid goal scarcity be like village people handwork – Ancelotti

Published

on

After Real Madrid manage play 0-0 draw with Real Betis on Sunday night, dem coachie, oga Carlo Ancelotti don come outside dey announce say diswan wey goals don dey scarce pass fuel for the club, the thing dey very strange.

Real Madrid pack one of the most dangerous fire power in the world for dem attack with players like the current Ballon d’Or holder, Karim Benzema, and the hottest young players like Vinicius, Rodrygo, Ernesto Valverde etc.

Yet for the last 3 games, this attack wey dangerous pass Russian missile dey struggle to score goals. Since after scoring 5 goals against Liverpool for Anfield, the champions of Spain don manage score only one goal for the 3 matches wey follow.

Them draw 1-1 with Atletico, lose 1-0 to Barcelona and the 0-0 draw with Betis. That result mean say dem don drop 4 points for La Liga in one week, and now Barca dey top dem with 9 points.

Carlo Ancelotti get Benzema for attack

Na all these things make oga Ancelotti don come outside dey squeeze face like candidate wey dem rig him election say, this scarcity of goals don dey look like the hand of village people dey inside. According to am:

You sef check am na, a whole Real Madrid wey na goals be our second name, yet na only 1 goal we don score in 3 games? And the goal sef na header from set piece. My brother e no possible. This goal scarcity dey very strange.

Oga Carlo Ancelotti say the thing dey pain am well well because the opportunities dey come but na conversion be dem problem now. And as e be now, Madrid can’t even make a down payment for a roasted corn and that needs to change sharply.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version