As e dey Go

If na me PSG fans dey boo like Messi, I go slap dem and dem papa- Ibrahimovic

Published

on

As PSG ultras continue to dey boo Lionel Messi anytime him enter pitch or even touch football, former PSG striker, Zlatan Ibrahimovic don come outside dey blast dem say dem get luck say no be him dem try dat madness with.

Ibrahimovic na PSG legend. The 41 years old Swedish striker play 4 years of him career, from 2012 to 2016 for PSG. In those 4 years, the big striker score 156 goals inside 180 appearances for the Paris giants.

But dis na Lionel Messi second season for the club and although him dey try him best, the club no dey live up to expectations. The Champions League wey be their main target, Bayern Munich don beat dem comot. Even the league self, small small clubs dey disgrace dem there.

Na diswan make the PSG fans and ultras dey provoke and right now, since na Messi be one of dem highest-paid players wey dem buy to come help dem win things, dem don kuku dey boo the 7 time Ballon d’Or winner anytime him enter pitch.

PSG ultras dey boo Lionel Messi and Zlatan Ibrahimovic no like am

Na wetin make Zlatan Ibrahimovic use anger take chook mouth inside the matter say wetin the fans dey do na nonsense and if to say dem try am during him time there, him for teach dem lesson wey dem no go ever forget. According to am:

”PSG ultras dey very lucky say na Messi dem dey boo. Because dem know say Messi no kuku send anybody so him go just troway face. If to say na me dem dey boo like dat, I go enter their middle, slap all of dem, slap dem papa and dem mama, then I go bounce leave the club forever. What nonsense?”

Lionel Messi don already prepare to leave the club after him refuse to sign contract extension. We also hear say PSG no kuku fit afford to keep him and Mbappe. Now the GOAT fit rejoin Barcelona or kuku decide to go Saudi Arabia where Al-Hilal dey offer am £6.7 million per week.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version