As e dey Go

Al-Hilal don offer to pay Messi more than double of wetin Al-Nassr dey pay Ronaldo

Published

on

We don dey hear now say Al-Hilal inside Saudi Arabia league don finally ready to do something on top Lionel Messi head because right now dem don sama the World Cup winner one hooge contract wey dey scatter brain.

According to the tory, Al-Hilal don offer Messi contract wey dem ready to dey pay am nothing less than $438 million per year. This na about £351 million and when we calculate am, we see am say na £6.75 million Messi go dey collect every week.

This one na more than double the salary wey Al-Nassr dey pay Cristiano Ronaldo because according to the other GOAT contract, him salary na £173 million a year. And if you check that money, na about £3.4 million per week. This means Messi fit become the highest-paid player ever in the history of football.

Al-Hilal dey offer Messi more than double wetin Al-Nassr dey pay Ronaldo

But we don dey hear now say Lionel Messi never ready to leave Europe go Saudi wey many people consider as retirement league wey many big players dey go just to collect pension before their career expire.

Although Messi don win more FIFA Best and Ballon d’Or pass anybody else, join am with the World Cup wey him don win use take settle the GOAT matter with Cristiano Ronaldo, e be like say the Argentine maestro still get one or two things to conclude before leaving Europe.

With the senior man refusing to sign new contract with PSG and as the club fans don kuku dey abuse am dey boo am for pitch, e dey clear say him journey for Paris don over.

Although him former club, Barcelona na the likely option for am to return to right now, clubs outside Europe ready to splash the cash like sugar daddy just to land Lionel Messi.

Inter Miami inside USA don first offer to nak the bobo the biggest contract in football history. And now, AL-Hilal don offer to make the highest paid in history. If him decide to take am, him go blindly become Odion Ighalo teammate for the club.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version