As e dey Hot

Messi say him go like play 2026 World Cup if old age no show am shege

Published

on

E be like say Lionel Messi no plan to quit playing football anytime soon because the living legend don come outside dey yan say as him dey so, him ready to play for the 2026 World Cup, as long as say age never begin show am shege by then.

Una remember say Messi captain Argentina win the 2022 World Cup wey shele inside Qatar, scoring 7 goals and 3 assists wey make am win the Best Player award for the World Cup and confirm himself as the Number 1 GOAT.

On top of that, the University of Qatar wan convert room wey the 7-time Ballon d’Or lodge inside during World Cup into Museum. E be like say na dis glory don enter the GOAT head wey don make am begin hunger for more to the extent of declaring to run for 2026 World Cup.

Qatar University wan convert dis lodge into museum in honour of Messi

According to Messi:

“I go like play 2026 World Cup but na if age allow me. Man’s not getting younger and although I dey the best shape of my life, 2026 still far well well and many things fit don shele before then. So depending on whether I still fit gbe body or not, I go know. But I for like play that World Cup.”

The 2026 World Cup go shele from June 3 to July 8 inside USA, Canada and Mexico. Lionel Messi don been talk say Qatar World Cup when him dey 35 years old go be him last World Cup but now the GOAT don dey consider the next one when him go dey 39 years old.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version