As e dey Go

My name no be Mbappe Saint Germain so make PSG no dey use me anyhow- Mbappe

Published

on

Paris Saint Germain superstar, Kylian Mbappe don come outside with anger and provocation take dey tackle PSG oga dem say why dem go use interview wey him do take promote next season ticket sales without telling am.

PSG run one advert for dem website to take promote their season ticket make more fans come buy. PSG use interviews with some of their players, including Kylian Mbappe take run the promo. Inside the interview, Mbappe talk about the club and the fans.

And as the club don use the interview take run dem ticket promo so, Mbappe don come outside with sliding tackle take dey tackle the PSG oga dem say why dem go try that nonsense with that interview without telling him? According to the France World Cup winner:

“PSG dey use me take sell market without informing me. E no make sense na. I don tell dem tire say PSG no mean Kylian Saint Germain so I no understand why dem go dey use my interview without telling me wetin dem wan use am for.”

Mbappe na the highest paid player for PSG

Mbappe say him no agree with dat interview and the next season ticket promo wey dem use am take run. Although him respect the club and the fans as a family, him no respect how dem dey abuse him image rights.

No be today be the first time wey Kylian Mbappe dey get problem with team wey him dey play for using him image take run promo. Last year, the bobo no gree take picture or take part in promo activities with France national team because of image rights.

Kylian Mbappe wey dey just 24 years old na PSG highest paid player, pocketing more than $1 million every week. Na diswan don make many people dey wonder why dem go dey pay am all those plenty money yet e go still dey complain about image rights.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version