Connect with us

As e dey Hot

Former Real Madrid defender, Cicinho don confess how ogogoro take destroy him career

Published

on

My people diswan na confession time o, as former Brazil and Real Madrid right back, Cicinho don come outside with tears of regret for him eyes dey confess how ogogoro take destroy him career as a footballer wey make am no reach him full potential. According to the bobo, him highness no get time or season because sometimes him dey even drunk and high to pieces in the morning before going for Real Madrid training.

During him time, Cicinho become one of the hottest players for market after the bobo help São Paulo win Brazilian Serie A, Copa Libertadores wey be dem South American champions league, and Club World Cup. Na diswan make Real Madrid rush go sign am come Santiago Bernabeu not knowing say na ogogoro drinker dem sign think say na footballer.

According to Cicinho, na when him dey 13 years old him first taste alcohol. The thing sweet am sotay him decide say na ogogoro be the best thing to ever happen after sliced bread. “Once I taste alcohol, I no fit leave am. Even as teenager for Brazil, na so I dey enter clubs and bars dey drink upandan use highness take dey return home.”

Cicinho togeda with Roberto Carlos and Robinho for Real Madrid training

”Even when Real Madrid sign me, I be serious ogogoro man. I no even dey buy am because people plenty wey ready to dey dash me free drinks. Na so I go drink finish carry highness take enter training. But because I no want make my coachie dem and teammates know say I don high, I go drink plenty coffee to remove the smell from my mouth then I go spray plenty perfume to remove the smell from my body. Walai talai sumobinlai, alcohol na bastard.”

After playing 2 out of him 5 years for Real Madrid naim the club find out say diswan no serious again so dem quickly sell am give Roma. But the spirit of ogogoro still follow am enter Roma even invite the spirit of smoking cigar join and togeda dem begin show Cicinho shege sotay na so-so loan Roma jus dey send am go because a player wey dey operate without him clear eyes, da wan na calamity wey dey wait to happen.

But now, at 41 years old, Cicinho don confess say him don finally get complete deliverance from the spirit of alcohol and him dey always apologise to him 15 years old pikin because na alcohol make am no enjoy good relationship with the boy. Cicinho don even dey preach against alcohol say: “ogogoro go make you forget about the people wey really love you and care for you because everytime you go dey surround yourself with ogogoro people wey no care about you, instead na alcohol be the only thing wey join una togeda like two danfo passengers wey conductor join togeda because of no change.”

As e dey Go

Guinea player wey accuse him coachie of stealing jersey wey Vinicius dash am go miss AFCON

Published

on

Guinea player wey accuse him coachie of stealing jersey wey Vinicius dash am go miss AFCON
Sylla sey him nor go gree unless the jersey come out

Guinea midfielder, Morlaye Sylla name nor dey the list of players wey go play this CAF African Cup of Nations wey go take place for Ivory Coast next month after him accuse Guinea national team coach, Kabba Diawara of stealing jersey wey Vinicius Junior give am when them play friendly match with Brazil for June this year.

Wahala start when Sylla find out sey jersey wey him swap with Vini Jnr wey him carry enter dressing room dey miss. Him start dey hala sey how jersey wey him carry enter dressing room go just borrow leg like that. Him start dey search everywhere.

Guinea player wey accuse him coachie of stealing jersey wey Vinicius dash am go miss AFCON

Guinea football coachie

After him search everywhere, him sey him go search all the players for the dressing room sey nah them steal am. Then later, him start to dey accuse their team coach, Kabba Diawara, sey nah him steal the jersey.

Nah this one make the coach and Guinea FA sey him nor go play for them again unless him apologize. But Sylla nor gree apologize. Him sey him dey on him right as him expect Guinea FA to focus more on who thief him original jersey wey nor be okrika.

Guinea go start their AFCON on 15th January when them go play Cameroon before them play Gambia and then defending champions, Senegal.

Continue Reading

As e dey Hot

I wan see more black coaches for professional football – Yaya Toure

Published

on

Black coaches deserve more chance according to Yaya Toure
What Guardiola and Mourinho can do, we can do put jara

Barcelona and Manchester City legend, Yaya Toure, don use microphone like hype man declare say more black coaches suppose dey professional football pass as e dey.

Yaya Toure wey leave Tottenham Hotspur U-16 for June this year go become assistant coach for Belgium with Standard Liege, don dey hala sey black coaches get everything wey any coach for world football need to succeed. According to am :

“My brother Kolo Toure nah the first and me don be second and e go continue like that. Black coaches go still become hot akara wey football clubs and national teams go dey rush. This nah because African coaches too get the ability to read and pass exams. In fact, nothing Guardiola and Mourinho fit do wey black coaches nor fit do”.

Black coaches deserve more chance according to Yaya Toure

What Guardiola and Mourinho can do, we can do put jara

Yaya sey him go like become the third coach to win African Nations Cup as player and coach after Muhammad El Gohary (1959 as player and 1998 as coach) and Stephen Keshi (1994 as player and 2013 as coach). Him say the opportunity don come before to coach him country, Ivory Coast but say him reject am because him never ready then. But say him don ready now.

Yaya Toure dey speak to journalists onto the African Nations’ Cup draw wey go shele on Thursday for Ivory Coast. Yaya and him brother follow for the Ivory Coast team wey win African Nations Cup for Equatorial Guinea 2015. As him don dey advocate for black coaches so, football people dey sey make black coaches sef dem try dey show workings sake of sey better soap nor need advert.

Continue Reading

As e dey Hot

Romelu Lukaku agents Roc Nation don drop am because him na bad market

Published

on

Romelu Lukaku agents Roc Nation don drop am because him na bad market
Lukaku issues don turn spiritual

Trouble don carry chair come balance for Romelu Lukaku house as e don clear sey Roc Nation wey belong to Jay Z don drop Lukaku from the list of players wey dem dey manage.

Roc Nation wey dey  also look after players like Marcos Rashford, Kevin de Bruyne, Wilfred Zaha, Samuel Chukwueze, Tyrone Mings, Eric Bailly and many others don comot all the photo wey resemble Lukaku comot for their website. People wey know as e dey go for football don confirm sey Lukaku and Roc Nation nor wan roll again.

Romelu Lukaku join Jay Z sports management company for 2018 after him leave Mino Raiola company after the super agent death. Nah the same Roc Nation carry am come Manchester United from Everton. Nah still dem carry am come Chelsea from Inter Milan last year. Nah still dem toast Chelsea wey dem for gree loan am go Roma after Chelsea bin sey nah only sell dem wan sell am.

Roc Nation wey belong to Jay Z don drop Lukaku

Lukaku matter don turn spiritual

This issue don dey make football people dey put 2 and 2 together because e never tay wey him betray Inter go discuss contract with Juventus for their back. E never tay too wey Juve fans dem carry fight go meet their club oga dem sey dem nor want Lukaku for their club. Then, Chelsea fans don play am tey-tey sey dem nor soro am onto how him insult their club for media under Thomas Tuchel.

All these issues put together don make Romelu Lukaku be like dog meat wey nobody wan buy. And as Roc Nation don decide to divorce am, we nor come know wetin happen gan-gan even as e clear sey Lukaku matter don turn spiritual.

Continue Reading

Trending