Wetin shele gan-gan

“Fake news!”- Cristiano Ronaldo don deny say him plan to join Sporting on loan

Published

on

Football legend, Cristiano Ronaldo don come outside dey shalaye say; una see all dat story wey people dey write upandan say I dey play to carry all my kaya jakpa from United go join Sporting Lisbon on loan ba? All those story na fake fake news dem be so make anybody no take those people wey dey talk am seriously.

According to the tory, some media houses for Portugal claim say dem see Ronaldo motor outside Sporting stadium which mean say him dey meet with the oga dem to help am escape from Manchester United. But the 37 years old runaway striker, him no get any plan to go join Sporting on loan because dem no bury him placenta there.

Cristiano Ronaldo wan jakpa from Manchester United because him dey feel too big to play for Europa League

Dis Cristiano Ronaldo transfer wahala don dey turn to anada tin since the bobo come outside begin grumble say him wan leave United. At first the bobo claim say na because United no dey buy players das why him wan jakpa. But when United begin buy players naim the bobo change mouth say make dem just allow am go.

But na later we hear the main tory say Ronaldo wey many people consider as the GOAT dey feel too big to play Europa League. And since na Europa League United dey go, him no fit follow dem go there because him need to protect him Champions League goal-scoring record (140) from somebody like Messi (125) wey na only 15 goals separate dem.

As e be now, Ronaldo wey dey 37 no get time again so him seriously dey hustle to comot from United go club wey dey UCL. Unfortunately the big clubs wey fit pay him salary like Chelsea, Manchester City, PSG and Bayern no need am. The ones wey fit need am no fit pay him salary. And na the gbege wey Ronaldo don find himself inside wey make am dey run kiti-kiti be dat.

Las las, unless one kind miracle happen, Ceistiano Ronaldo fit end up playing dat Europa wey him dey run away from, or make him kukuma go Sporting go play for charity for dem since na there him professional football story start from.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version