As e dey Hot

“Chelsea must offload Aubameyang to avoid stories that touch” – Neil Warnick

Published

on

As life for Stamford Bridge continue to dey carry Pierre-Emerick Aubameyang go where him no know, former Leeds and Crystal Palace coachie, oga Neil Warnock don dey draw ear give Chelsea coachie, oga Graham Potter say to avoid stories that touch, him better sell the former Arsenal striker immediately.

Aubameyang never see him period since joining Chelsea from Barcelona on top 10 million pounds contract. And since season start, the Gabonese striker don score only 1 EPL goal for Chelsea. On top of dat, injury no even wan gree the bobo see road.

But the one wey pain many people pass na during Chelsea Premier League match wey coach bring in Aubameyang to replace the injured Raheem Sterling only for coach to remove the guy again for playing igbakugba.

Oga Warnock don warn Potter to give himself sense and offload Aubameyang immediately

Although oga Potter dey yan say no be Aubameyang fault because him fatigue after just returning from injury etc, oga Warnock wey don coach 18 different clubs for him managerial career don warn oga Potter to forget all that balablu wey him dey talk and sell Aubameyang.

“A player like Aubameyang no dey play for the club again. Right now him just dey play to please himself. Him no care whether them sack the coach or not. We see wetin him do for Arsenal and Barcelona. E just be like Cristiano Ronaldo wey I warn Manchester United make them sell am. Those kind players sabi spoil team.”

Oga Warnock wey don record the highest promotion of clubs for English football history also talk say Ronaldo own good, at least na special player. For Aubameyang nothing special about am and as we can all see, him best days don expire, now na pension him just dey collect.

Therefore make Graham Potter pursue Aubameyang comot from Chelsea now wey day still break because no be for midnight them take dey find black goat wey loss.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version