As e dey Go

Wahala for Awoniyi club Nothingham Forest as dem dey owe players and agents millions of pounds

Published

on

Taiwo Awoniyi club, Nothingham Forest don enter one chance as e don clear sey dem dey owe players and agents millions of pounds onto bonuses wey dem suppose don pay dem since last year till now.

 

Immediately Nothingham Forest return to Premier League last season, dem run enter market go charter 21 players. By January transfer window the players wey dem sign don reach 30. For this transfer window, dem don sign only three players including Chris Wood, Anthony Elanga and Nigerian international, Ola Aina.

The matter don long because all the players and agents wey dey involved for all these transfers don dey threaten to carry dem go FIFA wey dey for take collect all the bonus wey dem owe dem. If this one happen, Forest fit suffer liquidation or dem fit send dem go relegation with immediate alacrity.

 

Nottingham Forest owner dey owe plenty igbese

This tory don wor-wor sotey plenty football people don dey wonder how club wey come Premier League just last season and nearly go relegation go come use wahala take baff like this. As the matter dey go Ogbomosho court so, people wey dey the club dey hala sey e don red.

As e be so, Forest still suppose pay some of the players and agents by end of this August wey we dey do. If dem fail to pay dem, nah in be sey dead body don get accident be that.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version