As e dey Hot

FIFA don ban Ronaldo club Al-Nassr from signing new players unto Ahmed Musa gbege

Published

on

As e dey hot we don dey hear now say FIFA don hammer one big ban on top the head of Cristiano Ronaldo club, Al-Nassr, say make dem no sign or register player again because of the wuruwuru wey dem do Leicester City  unto the signing of Super Eagles skippo, Ahmed Musa.

If una remember, na for 2018 naim Al-Nassr sign Ahmed Musa from Leicester City on top £14 million contract. According to the tory, dat contract also agree say Al-Nassr go pay other interests and add one especially if him perform well and help the club win trophies.

Ahmed Musa play 2 seasons for Al-Nassr with 62 games in total and 14 goals. The Super Eagles skippo also win the Saudi League with Al-Nassr before leaving the club as free agent go join Kano Pillars inside Naija League.

And after dem calculate all the performance add ons wey Al-Nader suppose pay Leicester City after Musa leave Al-Nassr, the total amount na £390,000. Na this money now naim Ronaldo club never still pay the former EPL champions.

Al-Nassr been don sign Ronaldo

According to the matter, na since 2021 dem don dey Al-Nassr to pay dis money otherwise dem go chop ban in the future. But e be like say then the club never know say dem go later big like dis so dem just dey play boju-boju with the money.

But now FIFA hammer don come down and as e be now, Al-Nassr no fit sign player for the next 3 transfer windows. And on top of dat, dem go still pay the full 390,000 to Leicester with interest.

Al-Nassr don sign Cristiano Ronaldo and Marcelo Brozovic from Inter Milan while dem dey warm up to carry Hakim Ziyech from Chelsea before dis ban now.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version