As e dey Hot

David De Gea don finally sign divorce papers with Manchester United

Published

on

Former Manchester United goalie, David De Gea, don finally sign divorce papers with United after 12 years of marriage. The number 1 announce this afternoon as e dey hot for Instagram sey him nor wan continue for the marriage again.

Una remember sey De Gea contract expire 30th of June and many people bin dey expect am to sign new contract wey dem don dey discuss since last year. According to many tatafo journalists dem, United give am chance to do wedding last weekend as dem nor wan let the contract matter disturb him and him new wife.

This announcement don make many United fans dey para sey dem nor gbadun the way the club handle David based on all the Goliaths wey him don kill for the club since wey him come.

De Gea and Henderson battle for United Number 1 jersey but in the end na De Gea win am

But De Gea dey tell all United fans dem one love and sey make dem coolu temper. According to him yarns:

“Nah beg I dey beg all United fans dem make una nor use cos of sey I dey comot dey vex for the club cos nah my decision to go face new challenge for anada environment. I nor believe sey wen dear Sir Alex Ferguson bring me come this club 12 years ago I go achieve everything wey I don achieve. I appreciate the love and support  from the fans since I come Old Trafford. I thank una well well and Manchester go always dey my heart and memory.”

As e be so, many people dey expect United to finally sign Andre Onana from Inter Milan for £43.2m before him travel for pre-season and United don agree to pay the bride price of that Ghana-Japan boy, Zion Suzuki from Urawa Reds Diamonds for €5m. As for Dean Henderson, e don sure sey him go join Nothingham Forest on permanent deal.

 

 

 

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version