Meet the players

Transfer news: Ronaldo don finally agree to stay Manchester United, Arthur Okonkwo don leave Arsenal

Published

on

For transfer news dis morning, e be like say the prodigal son of Manchester United, Cristiano Ronaldo don finally return to the club and based on wetin we see for him social media yesterday, the runaway striker don finally decide to stay complete him contract.

Na for one of him Instagram fan pages naim dem post say e be like say the GOAT go miss United friendlies against both Atletico Madrid on Saturday and Rayo Vallecano on Sunday. But Ronaldo respond for the comment section say: make una forget dat list, una see dat Sunday match against Rayo, the King must play.

Ronaldo don dey find way to japa from Manchester United since wey transfer window open sotay him manager don dey kiri the bobo like aboki dey kiri yam but despite everything, dem no find buyer. Although dem been claim say dem fit don get buyer, dis latest positioning now be like Ronaldo don finally use him teeth take count him tongue.

Naija blood Arthur Okonkwo don leave Arsenal on loan

Arthur Okonkwo for match with Arsenal

Young Naija blood, Arthur Okonkwo wey be Arsenal third choice keeper don finally leave the club go join Crewe Alexandra on loan. Crewe Alexandra dey play for League Two wey be the 4th highest league for England.

Arthur wey dey just 20 years old don dey Arsenal almost all him life. The tall keeper make 7 EPL appearances for bench last season and though many people dey yan say make Arsenal just kuku sell the guy because dem get many goalkeepers already, Arsenal no gree unto say dem get hooge plans for the boy.

Chelsea wey need striker wan go sign midfielder

Chelsea transfer window no dey show sign of encouragement because after signing Coulibaly put for defense, all the other moves wey dem dey make to try hijack other clubs jus dey backfire. Chelsea need striker so dem try to hijack both Gabriel Jesus and Robert Lewandowski transfer from Arsenal and Barcelona but e no work.

Cesare Casadei na 19 years old central midfielder

Dem also need one more central defender so dem try to sign Jules Kounde but Barca show dem who the real bandit be by hijacking the bobo from dem. But since dem no fit get the striker and defender wey dem need, dem don kukuma decide to go buy midfielder wey dem no need because we don don dey hear now say dem wan buy Cesare Casadei from Inter Milan.

Casadei na 19 years old Italian central midfielder wey many people don already dey compare with Marco Veratti. The bobo cost only 8 million pounds for market and e be like say Chelsea wan kuku use da wan take dey hold body until dem see bigger name to sign.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version