As e dey Go

Transfer news: PSG wan sign Marcus Rashford, Manchester United don agree price for Rabiot

Published

on

For transfer news dis morning, we don dey hear now say PSG don begin price Manchester United forward, Marcus Rashford with the mind to bring the guy come France as one of dem attackers.

Marcus Rashford na one of the best players to graduate from United academy but the guy never too dey see him period for the last 2 seasons, especially last season wey the guy provoke begin threaten say if dem no give am playing time, him go leave the club.

PSG coachie don yan say dem need one more extra striker and with the promise of better salary and Champions League football wey Manchester United no get, we fit see Rashford finally leave him boyhood club go where things go soft for am small.

Manchester United don agree transfer fee with Rabiot

Manchester United don agree transfer fee for Rabiot although many people don warn dem say na wahala player dem wan sign so

As Manchester United increase speed as dem dey hustle to sign Adrien Rabiot, we don dey hear now say Manchester United don agree transfer fee of 17 million euros with Juventus to take sign the France midfielder from there.

Wetin remain for United now na to agree personal terms like salary and bonus with Rabiot. Na because if dat wan Manchester United director, oga John Murtough go meet with Rabiot mama wey also be her agent, Veronique for Italy today.

Manchester City don agree to sign Sergio Gomez

Manchester City don agree to sign Sergio Gomez as dem new left back

We don dey hear now say Manchester City don agree to sign Sergio Gomez from Anderlecht on top 11 million pounds contract. Sergio Gomez na 21 years old Spanish player wey fit play as left back or as midfielder.

Manchester City need replacement for left back after dem sell Zinchenko to Arsenal. Na Marc Cucurella be dem first target but since e no work out, City kuku decide to look elsewhere and now na Gomez dem finally agree to go with. Gomez don score 6 league goals for 40 matches wey him play for Anderlecht.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version