As e dey Go

Thomas Partey: Arsenal midfielder don collect ‘small injury’ for Ghana

Published

on

Arsenal fans dey fast and pray make Thomas Partey return from international duty without any issues but we don dey hear say their prayer no answer because their star midfielder don collect small injury.

Na Ghana national team coach, oga Chris Hughton confirm the injury after Ghana AFCON qualifying match away to Angola wey shele on Monday. The Black Stars draw the match 0-0.

Na before the match naim Arsenal fans quickly notice say Thomas Partey name no dey for the starting line up. Immediately naim them begin raise alarm dey panic say wetin shele gan gan wey make Ghana sideline their star player.

Thomas Partey don sustain small injury for Ghana

And Ghana coachie don come outside now dey confirm say na one small injury wey the former Atletico Madrid midfielder collect naim make am decide to bench the guy. According to oga Hughton:

”Make I no whyne una, the truth be say Thomas Partey get small injury. The thing no big like that o, just a very small knock wey the guy sustain. So we just decide say we no go risk am, make the matter no go worse pass as e dey now. But true true, the injury no serious like that.”

Thomas Partey na one of the most important players for Arsenal as the club dey hustle to win their first Premier League title in nearly 20 years. Partey na also the most injury prone players as the bobo don miss 37 matches due to injury since him join the Gunners.

The matter serious sotay Arsenal send their top physio travel with Partey go Ghana to dey monitor am. Many pundits believe say if anything happen to the Ghanaian super star now, make Arsenal just sope otilor for that Premier League matter.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version