As e dey Hot

‘Since Ronaldo join us to win matches don dey hard for us’ – Al-Nassr players

Published

on

Cristiano Ronaldo don finally score him first goal for Al-Nassr and while him fans dey happy for the goal, some of him teammates don dey reason am say since wey the GOAT land for Al-Nassr, games don dey hard them to win because other clubs don dey tie wrapper well to play with all them power.

If una remember, even that goal wey Ronaldo score na late penarity wey Al Nassr take play 2-2 draw for them last match with Al Fateh. And out of the three matches wey the GOAT don play for Al-Nassr, dem manage win one (1-0) before losing 3-1 to Al Ittihad and then the last 2-2 draw.

Na this one don make Cristiano Ronaldo teammates for Al-Nassr don come outside dey yan say since wey the bobo join, to win match don hard pass Jamb because other clubs dey play and defend with them last power just to stop Ronaldo.

Al Nassr players say to win match don dey hard since Ronaldo join them

According to Al-Nassr midfielder, Luis Gustavo: “Na true say Ronaldo dey motivate players but sometimes na opposite motivation because him dey also motivate opponents to play well against us. So every other club now dey target us because of Ronaldo.”

Gustavo say you go see club wey dey lose match upandan like Bournemouth, once them jam Al-Nassr, them go begin play like Manchester City all because them wan perform well just to frustrate the former Real Madrid star. Na the problem wey them get now be that.

Na for December naim Cristiano Ronaldo abandon Manchester United go join Al-Nassr to become the highest paid footballer in history. But since then things never go as planned as him coachie sef don dey blame am say him follow cause why the club jabo from the Saudi Super Cup.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version