As e dey Go

Saudi league wan amend their law so that Messi go fit join any club with ease

Published

on

E be like say na Saudi league everything dey happen now as we don dey hear now say the league oga them don dey plan to change one of their laws ahead of when living legend, Lionel Messi finally decide to join them come collect pension money.

According to wetin we hear, Saudi league dey prepare to increase the number of foreign players wey any club fit register in a season to 8. Before now, the maximum number of foreign players wey any Saudi league club fit register na 7.

Una remember say that thing nearly cause wahala when Cristiano Ronaldo sign for Al-Nassr on top that £175 million a year contract. Na after the signing Al-Nassr realise say them already get 7 foreign players for the team meaning say one most go to make space for Ronaldo.

In the end na Cameroon captain, Vincent Aboubakar finally take the fall as the sacrificial lamb wey get to leave the club so that them go accommodate Ronaldo. Aboubakar currently dey play for Besiktas inside Turkey.

Saudi league authorities wan make sure say when Messi finally come him no go get problem

And a that kind thing the Saudi league oga them no go like make e happen again. Because after them don make Ronaldo the highest-paid player of time, them still dey warm up to nak something similar to Messi. So they no go like make Messi come and the club no get space for am.

The last match wey Messi and Ronaldo play together for Saudi loud well well sotay one businessman pay up to $2.6 million just to watch the two GOAT play together one last time. Na this kind huge opportunity the Saudi league oga them go don already dey eye.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version